Connect with us
odunlade adekola wife children

Nigerian Pidgin News Today

Odunlade Adekola Marks Wife’s 40th Birthday, Promises More Sweet Years Together

odunlade adekola wife birthday

Odunlade Adekola Marks Wife’s 40th Birthday, Promises More Sweet Years Together

Nollywood star, Odunlade Adekola don throw salute give im sweet wife, Ruth Adekola, as she dey add another year to her age today, 2nd November 2023.

Di gbedu wey full Odunlade belle no be here, as he carry video and foto join body, post for social media to yan about im madam new age.

Odunlade wey words no dey im mouth again, as love don scatter im head for di past 19 years wey e and im wife don dey together, e no get any yawa wey e fit talk.

Di bobo wey be proud papa of four bouncing boys, carry go Instagram go share some foto wey be say na only wen oga patapata celebration reach na im we dey see im wife for internet.

He throway salute give im wife say, na she make their 19 years together dey sweet like honey. E pray make dem live long well well, so that dem go fit celebrate more birthdays together for this life.

“Ruth Abosede Adekola, my own, na your birthday dey always make me lost for words! We don waka this love journey for 19 years now and not even one day you don make me regret why I carry all my love give you, Arike baby. Na your matter dey always dey my heart o. I dey pray make Baba God give us long life make we fit dey celebrate more years together for the name of Jesus.

IYAWO MI, SAAMUALAJO, na your birthday be dis o. Happy Birthday to you my darling wife.”

So na so Odunlade take show the whole world say love dey sweet when you dey with the right person. Happy Birthday to Madam Ruth Adekola, we pray make dis new year bring more happiness and blessings for una side. Na so we see am, no shaking.

Click to comment

Leave a Reply

Your email address will not be published. Required fields are marked *

More in Nigerian Pidgin News Today

Newsletter

Subscribe to our newsletter and stay updated.

Advertise On NaijaGists.com

Advertise on NaijaGists.com

LATEST UPDATES

To Top
NaijaGists.com - Best And Latest Nigerian, African Music Blog
error: Content is protected !!